
We dey one side laik dis, you dey di oda side Di mata wey divide us wide pass ocean. We say make you tok wetin dey your mind You say you no fit, say your mind don skata an’ e be like night don reach inside you for where We dey looku-looku ya face, your eye wey don wet. On the day of my funeral, let the sun delight your bodies. We don dey shout make you fit hear us Alaye! Sọ̀rọ̀ sókè! Clear us dis mata wella. If night don reach, we go find torchlight an’ e go shine pass dis moon wey be witness as We dey looku-looku ya face, your lips wey dey shake. Don't write my obituary, write my mother a new song. Plant flowers on my grave, far from unkind feet. How you go tiff awa joy? Tiff wetin neva efin manifest? The pawa wey your mouth carry no be muscle E carry weight pass dis ground wey hol’ us so as We dey looku-looku ya face, your hands wey don tire Since we small dey play enta di level wey we start to dey light spark dey tap PES dey sample babes E get wetin don gum us pass blood An’ base on dat thing, we dey here like dis We no sabi book no mean, fuck your tired metaphors Abobi reach us fess, use ya tongue divide this Red Sea Turn dis stones to agege wey we fit digest. Tomorrow we go siddon for your house An’ you go yarn us evrytin wey choke your neck But we go dey togeda and na so we go rugged am If faya dey burn man house Na plenti diffren’ hand go carry water quench di faya.